Actualités

Sport

Business

Culture

TV / Radio

Afrique

Opinions

Pays

Volta Lake drowning: Four people drown inside Volta Lake for Ghana

 117616616 Gettyimages 57324655 Information be say one of de victims be final year senior high school student

Thu, 18 Mar 2021 Source: BBC

Four people for Ghana die after dem drown inside de Volta Lake for Kpandu.De incident wey happen claim de lives of one final year female student, Evelyn Gadagoe den three others.

Local reports say she dey travel inside canoe plus ten other people when storm hit dem for de lake top. After de storm hit dem, six people survive but remaining four die.

E no clear who be de remaining three wey die, but information be say one of de victims be final year student for Kadjebi-Asato Senior High School.

BBC Pidgin dey follow up on dis for more updates.

Source: BBC