Actualités

Sport

Business

Culture

TV / Radio

Afrique

Opinions

Pays

Wetin be dis Super League, wey dey make Premier League, UEFA, FIFA, odas para?

 118106578 Gettyimages 1225539750 Di 12 clubs wey dey involved release joint statement on Sunday, 18 April

Lun., 19 Avril 2021 Source: BBC

European Super League: Premier League big six' don agree to join new league

Arsenal, Chelsea, Liverpool, Manchester City, Manchester United and Tottenham dey amond di 12 clubs wey don agree to form European Super League (ESL) wey be new league.

Di Premier League clubs go join AC Milan, Atletico Madrid, Barcelona, Inter Milan, Juventus and Real Madrid for dis plan wey don already begin shake di world of football.

Di clubs wey dey involved release joint statement on Sunday, 18 April.

ESL say di founding clubs wey start am don agree say di competition matches go dey happen for middle of di week but clubs no go stop dia normal-normal national leagues for dia kontries.

Di plan na to launch di women competition as soon as possible afta di men's tournament begin, ESL bin tok.

Football join bodi react

Uefa and di Premier League don condemn di plan for ESL when di tori comot on Sunday.

World governing body Fifa don tok am before say dem no go recognise any competition and any players wey chook hand for any league like dis and say dem fit deny di players chance to play inside di World Cup.

Uefa, wey be governing joinbodi for European football, release joint statement wit England Football Association, di Premier League, di Spanish Football Federation, La Liga and di Italian Football Federation and Serie A, say dem go dey "united" to try and stop di breakaway league with "all available measures".

Dem also sama dia own warning say players wey follow play inside di ESL go dey banned from all di oda competitions for domestic, European, world level and dem fit make dem no see dia national teams represent.

After di Super League announcement comot, Fifa say dem no approve di competition but dem say "all parties wey dey para for di mata, suppose discuss inside ‘calm, constructive and balanced’ tok-tok for di good of di game".

Football Supporters’ Association di reason why di clubs dey don join hand do new league na "greed".



UK Prime Minister Boris Johnson say di plans go "spoil tins well-well for football".

France President Emmanuel Macron give tuale to clubs for im kontri because dem refuse to join ESL.

How di format for ESL go be?

  • E go get 20 teams - di 12 founding members plus anoda three wey go join later. And then five clubs wey go qualify join.


  • E go start for August every year, and matche go happun for middle of di week.


  • Clubs dey inside two groups of 10, and go play home and away.


  • Di top three in each group gp qualify for di quarter-finals, and di teams for fourth and fifth place go play two-legged play-off for di remaining two spots.
  • After e go continue like di Champions League dey be before di single-leg final wey go happen for May for neutral venue.


ESL say dem go generate money pass di Champions League and go spread dis money well-well for all wey involve for game.

Source: BBC