Sport

Actualités

Business

Culture

TV / Radio

Afrique

Opinions

Pays

Ayade don cross river: Nigeria state govnor defect from PDP go ruling APC

 118581960 3cf3d03d 2fcb 479a B069 6d3670888c72 Govnor Ayade as im announce defection from APC take go PDP

Thu, 20 May 2021 Source: BBC

Cross River State Governor Ben Ayade don defect from PDP to APC.

Di event announcing Ayade's 'river crossing' happun today May 20 as di caretaker oga of di ruling party wit oda govnors visit Ayade for Calabar, di state capital.

Yobe State govnor Mai Mala Buni, na him officially announce the defection as im tok say: "We welcome His Excellency Executive Govnor of Cross River State Mr Ben Ayade formally into di APC.

"As from today, he is di leader of the party in di state," im add, as crowd wey gather for di event clap plenty follow the announcement.



Source: BBC