BBC

Actualités

Sport

Business

Culture

TV / Radio

Afrique

Opinions

Pays

MenuAfrique
BBC

AKA fiancé: Wetin we know about Nelli Tembe and how she take die

 117997347 125351216 736072623671321 7069550247896651417 N AKA don lose im fiance Anele 'Nelli' Tembe ova one month afta dem bin engage

Mon, 12 Apr 2021 Source: BBC

South African rapper, AKA don lose im fiance Anele 'Nelli' Tembe, ova one month afta dem bin engage.

Na di two families of AKA and im babe comot with statement to confam di death.

According to di statement, Nellie bin die for Sunday early mor-mor but dem no tok wetin kill am. She bin die at di age of 22.

About AKA wey im name na Kiernan Forbes, di statement say im dey "currently inconsolable and dey with im closest friend and family."

Anele Nellie Tembe, who was engaged to popular rapper Keirnan AKA Forbes, passed away this morning.

Though e neva clear wetin kill Nelli, tori be say she bin jump from tenth floor from hotel wey she bin dey stay with AKA for Capetown.

Na di emergency service, Netcare bin tok dis one on Sunday although dem no include her name.

Di couple Anele Tembe and Kiernan "AKA" bin share pictures of dia engagement for 21 Februuary, 2021.

Source: BBC