Menu

'We never see FG alert'- Delta goment on Ibori loot

IBORI6.png James Ibori, the former govnor wey loot goment moni

Wed, 26 May 2021 Source: BBC

Delta State goment don tok sey dem neva recieve di loot of former govnor James Ibori wey United Kingdom return to Federal goment.

Accountant general of di state, Joy Enwa tell tori pipo Wazobia FM say she hear say federal goment return di loot to Delta state for media.

"I know di account wey dem dey transfer di money. I neva see any money. As una take hear am na so I take hear am too. As we dey tok now I neva see any tin," Enwa tok.

Di Accountant General of the Federation (AGF), Ahmed Idris bin tok say dem don return di £4.2 million wey Ibori tiff to Delta state moment.

Idris tok dis wan wen im appear before di House of Representatives Ad hoc Committee on Assessment and Status of All Recovered Loots Movable and Immovable Assets from 2002 to 2020 by Agencies of the Federal Government of Nigeria for Effective Efficient Management and Utilisation.

"We pay di money to Delta State. Those main recoveries go specifically to states. Honourable Chairman, any recovery wey concern looted funds from a particular state dey to di state.

"Di state governors no go even allow us rest. Dem fit sue us and we no want dat kain ting."

Di Attorney-General of the Federation, Abubakar Malami on March 9 bin tok say dem go use di loot construct di second Niger Bridge, Abuja-Kano road, and Lagos-Ibadan Express road.

Malami say federal goment no go return to di Delta State goment wia dem tiff di money from but dis no go well wit plenty Nigerians wey argue say federal goment no get right to keep di £4.2million.

Source: BBC