Actualités

Sport

Business

Culture

TV / Radio

Afrique

Opinions

Pays

Okonjo-Iweala in Nigeria: See di issues WTO DG & Buhari discuss

 117583862 Ngoziokonjo Iwealameetsbuhari Okonjo-Iweala thank Buhari for nominating and supporting her

Mon, 15 Mar 2021 Source: BBC

Ngozi Okonjo-Iweala, di new Director General of World Trade Organisation meet President Muhammadu Buhari for Abuja, Nigeria Capital on Monday.

Madam Okonjo-Iweala for her meeting wit di Nigerian leader say she feel she suppose come Nigeria first, to say 'thank you, to Mr President';

She thank President Muhammadu Buhari for nominating and supporting her.

"He [President Muhammadu Buhari] sign so many letters, he tok to so many pipo," Ngozi Okonjo-Iweala tok.

Issues Ngozi Okonjo-Iweala and President Muhammadu Buhari discuss wen dem meet



—Improving Nigeria share of global trade

—Developing Nigeria Services sector

—Covid-19

—Attracting investment; training & capacity building

—Safe Schools

Director General of World Trade Organisation also thank young pipo for Nigeria specially. Dem dey on were on social media dey send so many encouraging videos.

Answering questions from tori pipo, she tok about di measures to protect national economies from dumping & oda harmful practices.

She tok say within WTO principles e get provisions wey exist to protect & support vulnerable kontris.

Dis na di first time di new Director General of World Trade Organisation dey meet di man wey nominate her for di job since she resume work on 1st March, 2021.

Ngozi Okonjo-Iweala don tok am loud say she, being di first female African head of World Trade Organization, wan do things differently for WTO.

Source: BBC