Opinions

Actualités

Sport

Business

Culture

TV / Radio

Afrique

Pays

Bitcoin: El Salvador legal tender go include cryptocurrency 'digital wallet'

 118822056 Bitcoinelsalvadorlegaltenderdigitalwallet Bitcoin usage don dey grow across di world

Mon, 7 Jun 2021 Source: BBC

El Salvador president say im go make di Bitcoin cryptocurrency legal tender for di kontri.

If congress support im plan, di Central American country go be di first for di world to formally adopt di digital currency.

Dem plan to use di Bitcoin alongside di US dollar, El Salvador official currency.

President Nayib Bukele say Bitcoin go make am easy for Salvadorans wey dey live abroad to send payments home.

"For di short term, dis go generate jobs and help provide financial inclusion to thousands outside di formal economy," Oga Bukele tell one Bitcoin conference for Florida, adding say e fit also boost investment to di kontri.

Source: BBC